"Rise Up" lyrics

2Baba & Falz Lyrics

"Rise Up"

As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dampen
So, ma guys na your eyes you go sharpen
You need to take care of yourself
Cos the curve go flatten
Better go dey start to dey happen

Know say gbege go come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We must to rise up again, eh
Gbege must come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We must to rise up again, eh

Yawa dey today but hey morrow go better
Gbege wey dey now e no go kill us never
I collect 1 Trophy make I take forget am
2 bottles with 2Baba we dey for gether
Make I keep am short o mi o fe soro ju
Everybody know say all my people dem dey colorful
When the gbege jam us for body we lost 1 or 2
And the matter hook us for neck we no no what to do
Stop there, turn round you go see action
Where man fall down, he go still rise up
Weytin no kill man na weytin make him sharp nah
And you no fit die for your film na you be actor
You go wide the chest like you be man o' war
You go wipe the dirt like you be janitor
You recharge the energy and start afresh
Weather you dey Budapest, Lagos city, Marrakesh

As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dampen
So, ma guys na your eyes you go sharpen
You need to take care of yourself
Cos the curve go flatten
Better go dey start to dey happen

Know say gbege go come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We must to rise up again, eh
Gbege must come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We must to rise up again, eh

The pepper go still rest, e go still rest ceteris paribus
Better go still come wey flexing go dey unanimous
All of my people turn, dey turn up till maximum
Bad water wey dey flow come no fit carry us
As I dey talk am so n gbo, sho gba mi gbo
All the kwanta wey you think say kole pari mo
Sofun Tolani, Chidera pelu Amina
Pe adura wa tigba ka ma sha mi mo
To the heroes we lost, we no go forget
Heaven prepare the medal wey dem go collect
Our black panther don unite with black mamba
When the time come, we go still jam for wakanda
When you get up help us, halla captain chika
And God bless the souls of Uwa and Tina
The time tough but no matter how e rough
Bad water wey dey flow come e no fit carry us

As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dampen
So, ma guys na your eyes you go sharpen
You need to take care of yourself
Cos the curve go flatten
Better go dey start to dey happen

Know say gbege go come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We must to rise up again, eh
Gbege must come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We go rise up again

This thing just wan test every man
The same thing dey happen inside inna every land
E no be competition
This one no concern politician
E just wan test every man
Same thing dey happen for every land o
This no be competition
This one no concern politic... politic...

As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dampen
So, ma guys na your eyes you go sharpen
You need to take care of yourself
Cos the curve go flatten
Better go dey start to dey happen

Know say gbege go come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We must to rise up again, eh
Gbege must come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We go rise up again


You May Also Like
Ice Prince - "Oleku" Woah woah woah woah woah woah woah woah (Ice Prince) Yeah yeah yeah yeah (Ice Prince) I-I-Ice Prince (I'm about to explode) (I'm about to explode) (I'm about to explode) Brymo (I'm about to explode)...
Phyno - "Ghost Mode" Ndi ara, Ndi ara, le le, lekwa ha A cho irim, A cho irim Ghost mode Otito diri Jesu Amen A burom anu enu but I'm flying up in the air mayn Nwanne a narigom ama do it over again I'm playing with the...
Olamide - "Turn Up" Oya turn up...turn up Oya turn up As we enter the venue we dey turn up ...we dey turn up When people hear the gbedu dem go turn up ...them go turn up Ladies they feeling the boy dem dey turn up...
Banky W. - "Heaven (Susu's Song)" 1 2 3 4, k K, yeah Just gonna let the chords play Let's go You asked a question and I, ain't gonna lie But, I wasn't ready still you took me by surprise You wanna know if I will, ever leave your...
Sarkodie - "Down On One" Ah, what else, now, aba, hahahaha You know say money no be problem What, let's go Mεn gya me hɔ kɔ fa boy fufrɔ Nia me de bε gya wo anka mede bε gye wo sutrɔ Wo da ma kuma su nti me tuma tiwo su...