"20 10 20" lyrics

"20 10 20"

Shey you never hear
About the things wey happen there
Abi your eye never clear
Mankind so wicked
Lets talk about my government
Open your mind and your ears
Wetin happen
Shey na jazz o
Make my people suffer suffer
All their nyanshes don dey open
Everything don scatter scatter

20th of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so water ooo water runaway my eyes
Nothing you go talk wey go justify the case of their murder

The Chief of Staff, the commander and the army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo ijoba
All your atrocity
All of your corner corner
Make all the deadbody disturb you for your dream

The money wey you thief yapa for your azza
You don turn our graduates to common beggars
All the book them go no matter
'Cause you no go get job if you no know godfather

The Chief of Staff, the commander and the army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo IJOBA
All your atrocity
All of your corner corner
Make all the deadbody disturb you for your dream

20th of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so water ooo water runaway my eyes
Nothing you go talk wey go justify the case of their murder

We give them many chances
Dem fail my people
And When we cry for justice
Them kill my people
Walahi all of you
Their lives are on you
We no go ever forget all the youths
Wey die for tollgate

20th of October 2020


Writer(s): Damini Ebunoluwa Ogulu, Gaetan Judd, Paul Bogumil Goller, Keven Wolfsohn
"20 10 20" is a reference to the 20th of October 2020, when the Nigerian Armed Forces shot at peaceful protesters demonstrating against the brutality of the country's special police unit SARS in Lekki, Lagos State. With this song, Burna Boy addresses the Nigerian President, the Governor of Lagos State, the Nigerian Armed Forces and the Nigerian Government. He posted on Twitter on October 23, "I HAVE NOT SLEPT since 20/10/2020. I close my eyes and all I see is Lekki toll gate. I've seen a lot of Violence and death in my Life but this is the one that has Traumatized me."
Burna Boy said in a statement, "The proceeds of this song will be used to support families of victims and people suffering affliction as a result of the Lekki shootings. May the heavens open and celebrate all our fallen heroes who have died for this movement from the very beginning. Rest in peace to all the beautiful lives lost."