"Church Mind" lyrics

Falz, Priesst & Kurdi Klymax Lyrics

"Church Mind"

Baba dey Jaiye for Lekki
Omo dey suffer for trenches
Bukata wey dey hold omo for neck
This one na baba Ozempic
Sapa olympics
Gbadura, Oluwa will fix it

Padi want secure him pocket alone
Ojukokoro turn am to pick me
Everybody getti freedom of foolery
Brotherly, abegi feel free
Zero Zero 1234
Take my AZA Oya credit am

At all at all na eem bad pass
Shey na why dem dey call am abegistan
O ri quick bag o ti loose guard
He go kiss feet he go lick nyash
See shit for him mustache
Please keep your distance

Many things wey
I no wan try
Many things wey
Shima wan buy
I want go heaven
I no wan die
Wickedness dey
Inside church mind

Oh my God what is this
Yahoo boy dey shout thief
Everybody dey collect
Cobhams gan dey see things
My baby say she wan wig
She don dey gum body since
No fit tell her say I no guide
Now that kind thing dey kill steeze
As long as you dey alive
I swear to God you don die
Money can't buy happiness
Wetin poverty go fit buy?
Olopa conclude I be criminal
Shey na dada be person crime?
I no look like wetin I dey face
Omo thank God say person fine

Ye leader of tomorrow see shege (shege)
Leaders of tomorrow still dey wait (wait)
Leaders of tomorrow don dey old o
Grandpapa dem still dey race
Be like the tomorrow don dey late
All of my padi dey relocate
Leaders of tomorrow don dey craze o
Wetin dey happen nau kileleyi, kileleyi?

Many things wey
I no want try
Many things wey
Shima want buy
I want go heaven
I no wan die
Wickedness dey
Inside church mind

People dey suffer but pastor dey tell us to pray
They teach us to never complain
If you get problem, don't bother to tell anybody
Say Jesus will show you the way
They talk say the dread wey I carry for head is blocking my blessings
Yet, politicians wey dey thief dey pay tithe and offering
Call him a saint

Poverty capital we too dey suffer but we no dey feel am
We feel say na norm
Police go stop you for dripping for Lagos
Dem fit to shoot your papa with a gun
I hear say EFCC don dey raid
I'm not a scammer but still l go run
This na the life I dey live for Nigeria
Yet nobody get mouth to talk say e wrong
Like bro what the fuck?
Ahh


EP: "Break Time" (2026)
Falz, Priesst & Kurdi Klymax - Break Time EP cover
You May Also Like
LADIPOE & Ema Onigah - "Many People" Tell me say I be the fantasy Shawty say I be the fantasy to the pretty girls Me took all the lesson me learn from my blessing Chasing the money me nah lose a bitch Hallelujah confraternity When the...
BNXN & Sarz - "Rum & Soda" Fi ibadi yẹn ṣe mi leṣe Soro ah dob uno I dey go through things it's complicated You're the one for me o You sabi play when you whine waist You go take money o You just dey whine me it's complicated...
DaVido - "I Know Who I Be" Who am I? I'm a bad guy My designer, waka-waka Balenciaga and Prada You must have gone insane if you think your story Your story is my story I know who I be (I know who I be) Who am I? I'm a bad...
YCEE - "Jagaban" Tinny entertainment baby Want to sing music Want to sing music You think music is for everybody This is a brand new from Tianu Ni Record radio station This is a ycee and he call this one jagaban...
Muyeez, Zerrydl, Ayo Maff & Famous PLuto - "Bank Alert" Muyeez baby oh Sound the alarm Say wara wara Ah la la la la Baby wanna do the popori easy Baby wanna come the gangster party I nor get money to sponsor the banny But she still day fall in by 6:30...