"Heya!" lyrics

"Heya!"

Everybody say them dey go their way
But I no think say, say we dey block each other way
Lai lai
You no go hear the people say
Say na our ignorance dey make life hard

Heya!
Heya!
Some dey talk and some dey walk and time just dey pass us by

Every woman dey look for man wey go love her right
Wey go ignore her shortcomings
Wey go take her like that
And every man, dey look for woman to hold tight
But na ignorance dey let love down

Heya!
Heya!
Some dey come and some dey go and love just dey pass us by

I don dey stubborn since the time I be small pikin
Na me dey always first see the problem, eh ah eh
Na me dey quit last, I no dey run fast
Papa say make I live freely like rich man pikin

Heya!
Heya!
I just dey fall, I just dey rise and time just dey pass me by
Heya
Heya
Some dey laugh and some dey cry and time just dey pass us by
Some dey work and some dey pray and time just dey pass us by


Writer(s): Ashimi Ibrahim
You May Also Like
2face Idibia - "Thank U Lord" A toba jaiye e Eleru iyin mo seba Oba nla nla nla nla T'in gbagbara lowo Eni t'in fagbara nini lara Oba to so wipe kaiye maa be kaa to be Mose iba o eledumare oba giga a Uuh Eko dunu binigi...
Banky W. - "Heaven (Susu's Song)" 1 2 3 4, k K, yeah Just gonna let the chords play Let's go You asked a question and I, ain't gonna lie But, I wasn't ready still you took me by surprise You wanna know if I will, ever leave your...
DJ Neptune & Davido - "Démo" Babe babe babe babe o Another one on replay Neptune here say shépe (OBO) Another one on replay OBO here say shèpe (DJ Neptune) Another one on replay (Baddest) Speroach here say shépe (Greatness)...
Tiwa Savage - "All Over" Baby Fresh on the beat and it's killing them all of course It's killing them all of course Make we scatter this place tonight Dance and sweating like say na fight We must to settle this thing...
Falz & Simi - "Enough" Hey Hey, hey When NEPA strike, you be my light oh When I dey cry, you be my smile oh I love you baby, that's right I love you baby, ah ah ah ah When I dey waka, you give me ride oh When I dey shame...