"Oyoyo" lyrics

"Oyoyo"

Wetin you do
I say I trust the process even when I no dey see result
I stand for queue
But e belike the green light for my traffic e no dey work
Who I see?
I see nobody, nobody, nobody but myself
Ojutiri
As dem no motivate me. I kuku motivate myself

I reached out to alot but them jonze meee
Dem do me wayo
Naso I bend down carry my load
No collateral to ask for loan

I reached out to alot but them jonze meee
Dem do me wayo
Naso I bend down carry my load
No collateral to ask for loan

See me now! Person wey dem no send before dem see me shout oyoyo
Even person wey follow shit for church dey see me shout oyoyo
Lambo truck inside traffic o! Dem see me shout oyoyo
Oyoyo oyoyo oyoyo

I live my life I no dey send them jhoor
Oye oye oyekemo
The matter no be today start from exodus
I go show them my true color
From Ikorodu to America
The hustle make me go deeper
I bin dey reason dem say no think am
I ready receive but there's no giver

And if to say na man dey run am e for don cast
For the money I for do jazz
I for do this I for do that
I see shortcut but shey I go last

Chineke moh Bikoyemegoo
All of my life make e dey meaningful
Make my blessings come in many folds
Many goals wey keeper no fit hold

I reached out to alot but them jonze
Dem do me wayo
Naso I bend down carry my load
No collateral to ask for loan

I reached out to alot but them jonze meee
Dem do me wayo
Naso I bend down carry my load
No collateral to ask for loan

See me now! Person wey dem no send before dem see me shout oyoyo
Even person wey follow shit for church dey see me shout oyoyo
Lambo truck inside traffic o! Dem see me shout oyoyo
Oyoyo oyoyo oyoyo


Writer(s): Temidayo Raphael Omoniyi
You May Also Like
DJ Mono P & ODUMODUBLVCK - "Koboko Plucker" World famous Yeah I was rolling with the highest bidder, eh eh eh eh I was rolling, I was rolling, eh eh I was rolling with the highest bidder I dey run am Undertaker pattern eh eh Demma call me the...
JAE5 & Lojay - "Watermami" JAE5 Tell me love don't last, and money can't fade away But girl, you do me magic like Leon Pell away You no believe in me, 'cause you believe I'm only problem again, again Baby, reason me, and if...
Ajebo Hustlers & Victony - "Ave Maria" Stubborn Oh no no no no no no no Stubborn Them no Dey tell person (Them no Dey tell person oh) Na you go learn lesson Tambolo no be mosquito I no look anybody gan ni I Dey set forma You still Dey do...
Balloranking - "Trench Kid" Uh-uhn Me don buckle, clean all my tears (Hello) And, if I say nothin', no mean say I dey fear, oh Boy Ranking (Along Came Tuzi) When raba no dey to buy original (original) We dey rock our okirika,...
Ayo Maff & Fireboy DML - "Dealer" Oyinade o Oya, oya, move Nobody fit good to you pass your mama Ọmọ, dúró de mi l'ọna ọja The thing wey you do for me, my brother Mo ran ti Durotimi Ladoja Lo ri titi ọlọda, I go call another Ọmọ if...