"Illusions" lyrics
"Illusions"
You carry boyi go yonder, you say he no go oh
Slavers boku round town hin brother tell am oh
Stand for your ground, make you no hurry follow go
Them dey sell people troway, my brother no go oh
The people them wey go river never return oh
Them say na mami water carry everybody go oh
For full moon, papa go farm he never return oh
Them say na the forest carry am swallow oh
Listen boyi, life no balance at all oh
You go place you no know, you no go return oh
Boyi feeling true, him heart dey beat for the road oh
Him fate na to follow them, follow journey go ah
Ah ah ah ah ah
Wetin I think I become ah
Ah ah ah ah ah
Na illusion them dey sell you so ah
Boyi look forth, him look out, no other place to go oh
He carry him few belongings, reluctantly follow go
For this life we dey, the thing you do you know oh
E better to go reach the place find how e dey oh
I talk am, I shout am boyi still dey travel go
Na destiny dey push man where him dey go ah
He try am, he fight am, urge strong no be small
The tori e dey the place where him dey go ah
Ah ah ah ah ahh
Na wetin I think I become ah
Ah ah ah ah ahh
Na illusion dem dey promise you so ah
Oga master no wan know value pig pass people oh
He say dem be property, with him dog dem equal oh
Boyi clean gun, he shave beard, Oga trust no other
He for adopt boyi, but him people hala
That night boyi take razor he shave am proper
The way Oga dey like am, no touch him moustache ah
Poison for soup, for family and the guards them
He slash master throat too from ear to ear ahhh
Ah ah ah ah ahh
Boyi na most wanted for strange country ah
Ah ah
He dey gather soldiers ah
From plantations he dey break boys free ahhh
Ehn ehn
My people
The main reason we gather here today, na him ehn, na him concern us now
Na there we dey go next
Ah today on behalf of the people of the city and the township, the entire tribe and our very very race, we go unveil this statue of boyi
We go give our honorable personality himself the scissors to use cut the ribbon
For service to humanity and to race and eh we salute you sir
We salute you well well, because you really don touch our lives, you don change our lives from generations to generations to come
Nothing go ever remain the same for us
Yes, this statue na the honor of your greatness and service
Thank you
Thanks to Ajayi_a1, Bob Deen for correcting these lyrics.
Writer(s): Ezenwa Ogbonna, Olawale Olofooro
- AZLyrics
- B
- Brymo Lyrics
You May Also Like
Wande Coal - "Come My Way" I know
Dem no want make the money to come my way
If dem know
Dem no go let the money to come my way
So I pray
Make dem no hear am wen the money come my way
Cos I know
Wetin I go do wen the money come...
Wizkid, Spellz & Tiwa Savage - "Ma Lo" Spellz on the beat
Tiwa Savage on this one eyeh
Wizkid e yo wamama
Make you yarn am as the thing go This kind thing I never see oh
My pressure dey high, calm me down oh oh
My girl hold unto me oh...
Timaya, Phyno & Olamide - "Telli Person" Yeh soundbowy, baddo, Phyno fino
Leggo
Yetunde, every night and day you like to samankwe
Brother nnamdi, all your friends dey work; your own na samankwe eh
I tell you, you no gree, I advise you, you...
Olamide - "Melo Melo" I no dey denge denge I no dey pose eh
My baby give me biscuit I want sugar
The things you do me, bi’ojo ba ro kose wi
Bi’orun baran, bi’orun ba’ran ko se so
Melo melo, melo melo la fe wi
Melo melo,...
Ice Prince & CKay - "Shakara" Ckay yoyoyoyo
Ice prince zamani
Girl, let me rock your body till the
Soco soco so
Let's make love till my
Soco soco so
I give you my heart oh
With extra love on top oh
Hmmm hmmm hmmm
E be true love...